My 9ja people them say "to start ajebo no be problem, na to maintain am be the issue." You fit? I been no know the wahala wey dey involved to friend oyinbo man (abi na boy i go call am). Since i begin friend oyinbo i neva see the kind thing wey i see this year. One small boy wey i been dey friend this year nearly put me for wahala, infact na gbese i dey na. To friend oyinbo no easy...if we dey go party we go carry drink go...me sef go carry wetin i go drink. If we go out me go pay my own too... the one wey shock me na one day wey we dey go bbq for him friend house. I buy my own MEAT carry go. Wetin person dey see for london.
So, my question na be say, what if we dey go owanbe, na so i go cook rice with amala carry go?
This kind life i no sure say i fit maintain because no be so dem take train us, my friends don laugh me tire. At least 9ja man know e duty, e know say "soup wey sweet na money kill am", at least he go still assist you to do fine hair. When i been dey friend one oyinbo na every 2 weeks i dey change my hair (after he go go display me for im yeye friends). I no sure say i fit dey change hair and dress everyday. As we dey enter this year so, i don renounce my ajebo lifestyle, now na full kpako i be.
I don tire to chop steak, foie gras, chateaubriand and drink chardonnay...now na amala, fufu, lafun, shaki, abodi, roundabout with ewedu i wan chop then I go wash am down with palmwine.
M'je
7 comments:
Who send you message? No leave oyinbo o...stay with them, when gbese go full your hand na then you go know....no run come meet 9ja men when fire burst. Oloshi...ok, i dey joke. Just use shame do U-turn come back to your own people...i sure say we go still accept you...see as your mouth be like roundabout and abodi.
xxx
Babe, I don laugh so tay belle dey pain me. U no lie sha, na when I been dey go out with omo-oyinbo, naim I realise say when person invite you come their house for a drink, you suppose bring drink when you dey come. see me see wahala. if you no get drink for house, why you tell me say make I come drink?
My sister, no be small thing...they way wey things be na e be like say na to find one Nija boy wey go dey take me out dey buy me Mr Biggs as e be say hinger go nearly finish person enemy for here. I still dey laugh....
make una dey laff ooooo no leave oyibo come follow ur black brothers wey know say if u dey do party drink go dey berekete n they no expect u to carry anything come cos e go be like say u dey insult them....
if u wan dey buy ur own drink evry weekend then stay put with oyibo else
join the band wagon of ur black brothers
My sister e no easy at all. Laugh wan finish me, anytime i read am na laugh i still dey laugh....
I remember the oyibo buddies I get here. Any time I pay for everybody's food and drink, na so dem go look me like say I don craze. Even to go watch football for dem house, you must to bring your own refreshment. Make you leave oyibo people with dem idea; we go keep our own too, shikena.
Too funny , yet so true.
Post a Comment